Nikola Karczewska (born 16 October 1999) be Polish footballer wey dey play as forward give Serie A club A.C. Milan den de Poland national team.
Karczewska begin ein career plus Polish second division side UKS SMS Łódź. For de end of de 2016–17 season, she help de club make e gain promotion to de Polish top flight Ekstraliga.
Insyd 2019, Karczewska sign plus Ekstraliga side Gornik Leczna. During ein first season plus de club, she help de club make e achieve league den cup double by winning both de Ekstraliga den Polish Women's Cup as well as dem achieve qualification to de UEFA Women's Champions League.[1]
Insyd June 2021, Karczewska sign plus Division 1 Féminine side FC Fleury 91.[2] She score ein first goal give de club insyd 1–0 win over ASJ Soyaux-Charente for 25 September 2021. She score ein first hat-trick give de club insyd 4-2 league win over AS Saint-Étienne. For ein lone season insyd plus de club, she make 24 appearances wey she net 10 goals give de club. She end de season as de club ein top scorer wey she help dem to dema highest league position to date by finishing 4th insyd de league.[3]
Insyd July 2022, Karczewska sign plus Women Super League side Tottenham Hotspur.[4] For 24 September 2022, she make ein club debut insyd 4–0 loss against Arsenal insyd league match.[5] She score ein first goal give de club insyd FA WSL Cup win against Reading for 2 October 2022.[6]
For 5 September 2023, Karczewska join Bayer Leverkusen for season long loan.[7]
After good spell insyd Germany in terms of performance, for 28 June 2024, she join Serie A club A.C. Milan for permanent deal.[8]
Karczewska represent Poland for dema U19 women's national team insyd before she make ein first appearance give de Polish women's national team insyd 1–0 loss to Slovakia for 14 June 2019.[9] She score ein first goal give ein country for 7 April 2022 against Armenia. She go on go score total of 6 goals insyd de same match.[10]
As of match dem play 11 December 2023[11]
Club | Season | League | National cup | League cup | Continental | Total | ||||||
---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|---|
Division | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | Apps | Goals | ||
Gornik Leczna | 2019-20 | Ekstraliga | 12 | 13 | — | — | 3 | 3 | 15 | 16 | ||
2020-21 | Ekstraliga | 22 | 23 | — | — | 4 | 1 | 26 | 24 | |||
Total | 34 | 36 | — | — | 7 | 4 | 41 | 40 | ||||
FC Fleury 91 | 2021-22 | D1 Féminine | 21 | 10 | 3 | 0 | — | — | 24 | 10 | ||
Tottenham Hotspur | 2022-23 | WSL | 14 | 2 | 2 | 0 | 3 | 2 | — | 19 | 4 | |
Bayer 04 Leverkusen | 2023-24 | Frauen-Bundesliga | 8 | 4 | 2 | 3 | — | — | 10 | 7 | ||
A.C. Milan | 2024-25 | Serie A | 0 | 0 | 0 | 0 | — | — | 0 | 0 | ||
Career total | 77 | 52 | 7 | 3 | 3 | 2 | 7 | 4 | 94 | 61 |
As of match dem play 6 December 2023[12]
National team | Year | Apps | Goals |
---|---|---|---|
Poland | 2019 | 3 | 0 |
2020 | 1 | 0 | |
2021 | 7 | 0 | |
2022 | 9 | 8 | |
2023 | 1 | 0 | |
Total | 21 | 8 |
Scores den results list Poland ein goal tally first, score column dey indicate score after each Karczewska goal.
No. | Date | Venue | Opponent | Score | Result | Competition |
---|---|---|---|---|---|---|
1 | 7 April 2022 | Stadion Miejski, Gdynia, Poland | Armenia | 1–0 | 12–0 | 2023 FIFA Women's World Cup qualification |
2 | 3–0 | |||||
3 | 4–0 | |||||
4 | 7–0 | |||||
5 | 8–0 | |||||
6 | 12–0 | |||||
7 | 12 April 2022 | Ullevaal Stadion, Oslo, Norway | Norway | 1–2 | 1–2 | |
8 | 6 October 2022 | Estadio Municipal de Chapín, Jerez de la Frontera, Spain | Morocco | 4–0 | 4–0 | Friendly |
Gornik Leczna