Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Amerika |
Orijina nem | Olubankole Wellington |
Fest nem | Olubankole |
Famili nem | Wellington |
Alias | Banky W. |
Wen dem bon am | 27 March 1981 |
Ples wey dem bon am | Amerika |
Pesin wey e mari | Adesua Etomi |
Fest langwej | English langwej |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Naijá langwej, Yoruba Langwej |
Langwej wey e tek rait di wok | English langwej |
Ancestral home | Naija |
Wok wey e dey du | pesin wey dey rait song, rapper, actor, singa, politician |
Wie e go skul | Rensselaer Polytechnic Institute, New York Film Academy |
Wen e stat wok | 2002 |
Rilijon | Christianity |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Instrument | voice |
Stai of song abi fim | rhythm and blues |
Record label | Empire Mates Entertainment |
Official website | http://www.bankywonline.com/ |
Personal pronoun | L485 |
Olubankole Wellington (Dem bon am for March 27 1981) wey meni pipu no am wit im stage nem as Banky W. bí Naija singer,rapper, actor, politishian and entrepreneur. Banky w wey pipu no as motivational spika for one interview wit TVC news Im clear di rumors wey pipu dey carry say im na pastor im kom tel TVC nius sey no bi pastor oo!But im na God pikin wey dey gro spiritually e stil tok sey im like share im experience wey im get with di lessons wey im dey len fom and di tins wey God don teach am. Banky w say if e fit hep young pipu kom near God even for dis hard time and still give backbone wey dem need an di wey wey dem need to succeed for life and Im fit do all dis tins bikos of di wisdom wey God giv am.
Olubankole Wellington dem bon for United States for 27march 1981 and Im Papa and Mama na original Niger pipu. Im family dem come bak to Nigeria wen e dey five years old. Banky w stat to dey sing wen e be smol boy and e dey among di Chorch choir.
Banky w primary and secondary schools na Lagos e go am later e kom go New York wia e get scholarship to skul for Rensselaer polytechnic institute. Im start e own record label E.M.E for 2002 as e dey study and e still dey work with Globalspec for in working place e dey sing loud with di headphone for im head. For 2009 e commot for US come back to Nigeria and make e own record label for Lagos way e sign artist like Niyola, Shaydee, Skalds and WizKids for di record label dat time. Im breaktru debut studio album Back in di Building e release am for 2005 Banky w raite di first theme song for Etisalat Nigeria wey di title na "0809ja for life".
One day after Valentine for 2013 Banky w launch im new album "R&BW" with concert tag wey be "Grand love concert" wey dem do for Civic centre Ozumba Mbadiwe Victoria Island Lagos Wey e feature plenty other artist including Iyanya and Waje. Di first two singles for di album wey be "lowkey and Yes/No".
Banky w announce for February 2018 say im don end E.M.E record label e get new label now wey bi Talent management company wey focus on creative marketing, advertising, PR, and brand events. DJ xclusive, Ebuka Obi Uchendu, Tolu Toolz Oniru, and Banky w wife Adesua Etomi na dem be di first set of client for Banky w rebranded company.
For 2017 Banky w take part for di initiating of di monumental heirloom, di philosophers legacy.
For 11 November 2018 Banky w come out say im go like run for di Lagos Eti-Osa federal constituency seat for Nigeria house of representative for di platform of modern Democratic party wey dem form for 2017. For 23 February 2019 Banky W Wellington lose di Eti-Osa federal constituency election to Babajide Obanikoro wey Im party be All progressive Congress.
Banky w marry Adesua Etimo for traditional way for 19 November 2017 and after for di same year 25 of November dey do white wedding for South Africa. For di same year e go for skin cancer surgery way be say di surgery go successful. For early 2021 Banky and Adesua born one boy.