Dele Odule (dem bon am for November 23 1961) na Naija fim aktor an fim meka. Im nem dey among pipu wey for win as Best Supporting Actor (Yoruba) for di year 2014 bikos im akt wel wel for di fim Kori Koto. Na im bi di oga pata pata for Theatre Art and Movie Practitioners Association of Nigeria.
Dem bon Odule for Ile-Ife, for Osun Stet but im kom from Oru Ijebu, for Ijebu Noth lokal govment for Ogun Stet for di year 1961, na fom there im go skul. Im stil go anoda skul for im Grade II Certificate wey im kolet to sabi Len how to tich pipul, afta dat one im go University of Ibadan, for Oyo State to go len Theatre Art.
Dele stat to dey akt for 1 grup wey bi Oloko Theatre Group wey Mukola Adebisi arenj.Dem sabi am for 1986 wey im fes komot as aktor but pipul kon sabi am wel wel as im akt for inside Ti Oluwa Ni Ile fim.sins dat time im don akt ova 200 fims.