Man abi wuman | man ![]() |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija ![]() |
Nem for lokal langwej | Godswill Akpabio ![]() |
Wen dem bon am | 19 December 1962 ![]() |
Pesin wey e mari | Ekaette Unoma Akpabio ![]() |
Fest langwej | Ibibio ![]() |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej, Ibibio, Naijá langwej ![]() |
Langwej wey e tek rait di wok | English langwej ![]() |
Wok wey e dey du | politician ![]() |
Post wey e dey | Governor of Akwa Ibom State, member of the Senate of Nigeria, Minister of Niger Delta, President of the Senate of Nigeria, member of the Senate of Nigeria ![]() |
Wie e go skul | University of Calabar, Nigerian Law School, Government College Umuahia ![]() |
Party wey e dey for politis | All Progressives Congress, All Progressives Congress ![]() |
E pipul | Ibibio people ![]() |
Godswill Obot Akpabio CON (dey bon am 9 December 1962) na Naija lorya an politishan. akpabio bi di koret Sineti presidet of Naija. E don bi di minista for Niger Delta Affair from 2019 go rish 2022. Akpabio don bi di govno of Akwa Ibom Stet from 2007 go rish 2015.
Dey bon Godswill Obot Akpabio on 9 December 1962. E papa nem na Obot Akpabio an e mama nem na Lucy Obot Akpabio ( e mama nem bofor e mari na Inyangetor). Akpabio mama kom from Ukana, Ikot Ntuen in Essiem Udim Lokal Govamet Aria. Wen Akpabio stil dey smol, e papa kpai. Na Akpabio mama train am.
Akpabio go Methodist Pamari Skul, Ukana, Essien Udim LGA, Akwa Ibom Stet. For e sekondiri skul edukeshon, Akpabio go Fediral Govamet Kolej Pot Hakot, Riva Stet. For e Yunivasiti edukeshon, Akpabio go Yunivasiti of Kalabar, Kross Riva Stet. From di Yunivasiti, e rid Law. Wen Akpabio de sekondiri skul, dey mek am di Senior boy of di skul. Wen Akpabio de Yunivasiti, dey mek am di spika of di house.
Akpabio granpa, Okuku Udo Akpabio bi di shif Polis ofisa in Ikot Ekpene aria wen e de alive. Akpabio onku Dr.I.U. Akpabio bi di Minista of Edukeshon/Intanal Hafihas for di Easta Naija dat time. Justice Nsima Akpabio, wey bi Akpabio korsin bi sineto in di Sekod Naija Riploblik. Akpabio na kristen an na Katolik Chorch e dey go. Akpabio wife na Ekaette Unoma Akpabio. Akpabio wife bi di fonda of FLEI (Famili Life Enhasmet Initiative), one hoganaseshon wey dey helep famili-dem to fit live well. Na five pikin Akpabio an e wife get; four boys an one girl.
Akpabio do smol tisha wok bifor e wok for Paul Usoro and Co., one law kompini wey de Naija.
Akpabio don also wok for EMIS Telikom Limited, One telifone kompini wey de Legos. In 2002, dey mek Akpabio CEO of di Kompini. Akpabio don bi di Seketiri of ATCOM ( Assosiashon of Telikommunikashon Kompini in Naija]] wen e dey wok as CEO of EMIS.
Govno Obong Victor Attah of Akwa Ibom chuz Akpabio as di kommishonal for Petrolium an Nashoral Risosis. Bitwin 2002 to 2006, na three aria of the ministri, Akpabio kontro:
Akpabio win di pamari eleshon wey PDP Pipo Demokrasi Parti to bi dia govno kandidet for Akwa Ibom.
Akpabio win di eleshon to bi di govno of Akwa Ibom. Akwa Ibom win di sekod term eleshon to kontiniu to bi di govno of Akwa Ibom for di sekod time.
Dey pik Akpabio to bi di chairman of PDP Govno Hasembili
Akpabio win di eleshon to bi di Sineti of di Akwa Ibom North-West Senatorial District, (Ikot Ekpene)
Akpabio risain as di lida of Sinetor Minoriti Lida bikos e komot from PDP enta APC.
Forma presidor Muhammadu Buhari chuz Akpabio to bi di Minista for Niger Delta Affairs.
Akpabio risain as di Minista for Niger Delta Affairs bikos e wan go for presidet of Naija onda di APC parti. Akpabio gree mek APC chuz Bola Tinubu as dia kandidet. Akpabio win di pamari eleshon wey APC do for pipo wen wan go for Akwa Ibom North-West Senatorial District
Akpabio win di PDP kandidet Emmanuel Enoidem to bi di sineti of Akwa Ibom North-West Senatorial District. Na 115, 401 vote Akpabio get. Emmanuel Enoidem get 69,838 vote. On 13 June 2023, Akpabio bikom di sineti presidet of Fediral Ripoblik of Naija.
EFCC (Economic and Financial Crime Commission|Ekonomik an Finanshial Krime Kommishon]] hakuss Akpabio sey e chop 100 billion wen e bi di govno of Akwa Ibom Stet from 2007 go rish 2015. But di kases no gree enta kot mek joj-dem luk into am.