Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Orijina nem | Harrison Tare Okiri |
Fest nem | Harrison |
Famili nem | Okiri |
Alias | Harrysong |
Wen dem bon am | 30 March 1981 |
Ples wey dem bon am | Wado pidgin |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | English langwej |
Wok wey e dey du | pesin wey dey rait song, singa, instrumentalist, performing artist |
Wen e stat wok | 2008 |
Eye kolor | brown |
Hair kolor | black hair |
Instrument | voice, guitar, drum, piano, conga |
Stai of song abi fim | rhythm and blues, dancehall, highlife, African hip-hop, African popular music |
Awod wey e kolet | The Headies, The Beatz Awards 2021 |
Nominated for | Nigeria Entertainment Awards, Nigeria Entertainment Awards |
Personal pronoun | L485 |
Harrison Tare Okiri, wey plenti pipu sabi for im wok as Harrysong, na Naija singa, song raita an e sabi uze instrumet sing e popula wel wel afta e sing for Nelson Mandela wen e kpai. Na Harrysong win Headies "Most Downloaded Callertune Award" 2013. Dem bon Harrysong for warri, Delta Stet, Nigeria to mama an papa wey bi Ijaw, e leta kom Legos in 2007 afta e don yuz som taim for Port Harcourt. Bifor e sign for QuestionsMark Entertainment, Harrysong dey holways pafom for naight klobs til e ci Kcee wey mek am sabi som oda ogbonge musikshan. In 2014, Harrysong nem dey insaid pipu wey fit win "Best pop/ R&B Artist of di Year" for 2014 Nigeria Entertainment Awards afta e rilis "Beta Pikin".
Dem bon Harrysong for Warri, Delta Stet. Na knli Harrysong im papa an mama bon, im papa an mama na Ijaw pipu, afta im mama kpai anoda wuman e dey wit no du am wel, wey mek am no finish skul. Na for Port Harcourt e tek du muzik wel wel.
Wen e dey eleven years old e tek to dey du musik for chorch an na im mama bi im diarekto. Insaid 2007, e muv go Legos as leed singa for a live band wey dey pafom evri naight klobs bifor e ci Kcee wey hep am to join Five Star Music. Plenti pipu sabi am afta e sing "Im in Love" an "Taiye and Kehinde" an na di song video top Trace TV video chart.
On June 22, 2017, Harrysong waif bon twins wit Alexer Perez Gopa wey dia nem na(boi; Perez & girl; Tare). On February 4 2021, Harrysong konfam im engagement wit Alexer Perez Gopa for im Instagram pej, an dey mari on March 27 2021, in Warri.
Year | Award ceremony | Prize | Recipient/Nominated work | Result | Ref |
---|---|---|---|---|---|
2013 | 8th Nigeria Music Video Awards | Best Pop Extra Video | "I'm in Love (Remix)" | Nominated | [9] |
The Headies 2015 | Most Downloaded Callertune | "Tribute to Mandela" | Won | [10] | |
2014 | 2014 Nigeria Entertainment Awards | Best Pop/R&B Artist of the Year | Himself | Nominated | [11] |
9th Nigeria Music Video Awards | Best Contemporary Afro Video | "Kolombo" | Won | [12] | |
Best Pop Extra Video | "My Story" | Won | [13] | ||
2015 | The Sun Awards 2015 | Creative Person of the Year | Himself | Won | |
2016 | 2016 Ghana Music Awards | African Artiste of the Year | Himself | Nominated | [14] |
2016 Nigeria Entertainment Awards | Best Collabo | "Reggae Blues" | Nominated | [15] | |
2017 | The Headies Awards | Best Pop Single | "Reggae Blues" | Won | |
2021 | The Beatz Awards | Special Recognition Award | Himself | Won | [16] |