Joseph Ayo Babalola (dem bon am for April 25, 1904 and e kpai for July 26, 1959), wey pipo sabi as Apostle Joseph Ayo Babalola, na di late Naija ogbonge pastor, prophet, apostle and di fes genera evagelis of di Christ Apostolic Church. Na im bi one of di lidas of di church wey mek plenti pipo kom to di church becos dat time e dey bring divine healing to di sick.[1]
Di kpai of Joseph Ayo Babalola hapun for 26 July 1959 for Ede, Osun Stet, Naija. Dem tok say Babalola show "no sign of illness" bifor e kpai.[2]
Isaiah Ogedegbe na im ripoblish one atikul abaut how Joseph Ayo Babalola take kpai and na im mek di tori to trend for som websaits.[3][4][5][6] But na one Baba Abiye for Ede na im fes tok di tori of im kpai.
{{cite web}}
: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)