Kafanchan (Fantswam: A̱byin Fantswam; Nikyob: Manɡyanɡ) na town for di south pat of Kaduna Stet, Naijá. Kafanchan dey popula bikos railway pas along di ples, as e dey sidon ontop di Nigerian Railway Corporation (NRC) station jonshon wey dem bi mek for 1927,[1] e kom stil sidon join for di railway line wey konet Port Harcourt, Enugu, Kafanchan, Kuru, Bauchi, e kom kaput for Maiduguri final-final.[2] For year 2007, Kafanchan bin get pipul wey dem go rich 83,092.[3]