Man abi wuman | man |
---|---|
Wen dem bon am | 12 January 1965 |
Ples wey dem bon am | Ilaje |
Wok wey e dey du | politician |
Post wey e dey | Deputy Governor of Ondo State |
Lucky Orimisan Aiyedatiwa (dem bon am on 12 January 1965) na Naija biznesman and politishan wey don sarf as govnor of Ondo Stet sins 2023. E don sarf as Deputy Govnor of Ondo Stet fom 2021 to 2023 onda Governor Rotimi Akeredolu.[1][2] Na bifor bifor kommishona of Niger Delta Development Commission.[3]
On 12 December 2023, Na Aiyedatiwa bi akting govnor wen Govnor Rotimi Akeredolu for medikal leev.[4] E don sarf as aktin govnor fom June to September 2023 wen Akeredolu dey on medikal leev. [5]
Dem bon Aiyedatiwa on 12 January 1965, e kom fom Obe - Nla, plez wey dem dey produs oil for Ilaje Lokal Govmet of Ondo Stet.
Lucky du im primari skul edukeshon for Saint Peter's UNA (nau FAC) Primari Skul, Obe Nla/Obe Adun insaid Ilaje LGA of Ondo Stet insaid 1970 an 1976. E du im Sekondri edukeshon for Ikosi High Skul, Ketu, Legos, in 1982. In 1986, e kolet Nigeria certikate in Edukeshon (NCE) in Ekonomiks an Govmet fom Legos Stet College of Edukeshon (nau Adeniran Ogunsanya College of Edukeshon), Ijanikin, Legos, e leta go Universiti of Ibadan for advans Diploma in Biznes Adminstrashon in di year 2001. E go Legos Biznes Skul - Pan Atlantic Universiti, Lekki, Legos wia e tek get Post Graduate Certifikashon in Chief Exekutiv Edukeshon (CEP) in Biznes Management in 2009. In 2013, e get Masta's Digre in Biznes Adminstrashon (MBA) fom Universiti of Liverpool, United Kingdom.Skul, Ketu, Legos, in 1982. In 1986, e kolet Nigeria certikate in Edukeshon (NCE) in Ekonomiks an Govmet fom Legos Stet College of Edukeshon (nau Adeniran Ogunsanya College of Edukeshon), Ijanikin, Legos, e leta go Universiti of Ibadan for advans Diploma in Biznes Adminstrashon in di year 2001. E go Legos Biznes Skul - Pan Atlantic Universiti, Lekki, Legos wia e tek get Post Graduate Certifikashon in Chief Exekutiv Edukeshon (CEP) in Biznes Management in 2009. In 2013, e get Masta's Digre in Biznes Adminstrashon (MBA) fom Universiti of Liverpool, United Kingdom.
E don wok as Inventory/Store Offisa for Scoa Assembli Plant Plc. Apapa, Legos, insaid 1982 and 1983. Insaid 1987, e bi di Assistant Head Ticha at Reliance International Schools, Ijokodo, Ibadan. E don wok as Marketing Offisa for Universal Pharmaceutical Supply Co. Ltd, Ikeja, Legos insaid year 1990. Insaid 1992, na im bi di Assistant Investment Analyst. Global Trust Limited, Gbagada, Legos, e bi bifor bifor General Merchandise Manager, Biz Mart Nigeria Limited, Legos Island, Legos, 1994.
E stat politis in 2011 wit Action Congress of Nigeria (ACN) wey leta join som oda parti to bi All Progressive Parti (APC). E dey insaid pipu dem selet to stan for dia parti of Ondo Stet APC insaid All Progressive Parti Convention wey dem du for Abuja in 2014.