Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Queen |
Wen dem bon am | 11 August 1981 |
Ples wey dem bon am | Lagos |
Wok wey e dey du | actor |
Wie e go skul | Nnamdi Azikiwe University |
Wen e stat wok | 2004 |
Notable work | Chetanna |
Queen Nwokoye (dem bon am for August 11, 1982) Naija aktres. Pipul sabi am wel wel wen e bi di main akto for di 2014 fim wey di nem na Chetanna. Na dis fim mek am win di "Best Aktres" nomineshon for di 11th Africa Movie Awards.
Dem bon Nwokoye for Lagos Stet inside Katolik famili bot e kom fom Ovim for Isuikwuato lokal Govament of Abia Stet for Naijá. E stat to dey go skul for Airforce Primary School. Afta dat, e finish sekondri skul for Queens College Enugu bifor e kom go Nnamdi Azikiwe University Awka, Anambra Stet wie e go rid Sociology and Anthropology. E bin get mind sey e go bi lorya.
Sins wey e first du fim for 2014 for di fim wey di nem na Nna Man, Nwokoye don kom dey show face for plenti Naija fim dem. E win awod-dem an get nominashon-dem.
Year | Awod serimoni | Prize | Resot | Ref |
---|---|---|---|---|
2011 | 2011 Best of Nollywood Awards | Best Supporting Actress in an English Movie | Nominated | [2] |
Fresh Scandal Free Actress | Won | [3] | ||
2012 | Nollywood Movies Awards | Best Actress in an Indigenous Movie (non-English speaking language) | Nominated | [4] |
2013 | Best of Nollywood Awards | Best Lead Actress in an English Movie | Nominated | |
2014 | Nollywood Movies Awards | Best Indigenous Actress | Nominated | |
2015 | 11th Africa Movie Academy Awards | Best Actress in a Leading Role | Nominated | |
Zulu African Film Academy Awards | Best Actor Indigenous (Female) | Won | [5] | |
Best of Nollywood Awards | Best Actress in a Leading Role (Igbo) | Won | [6] | |
2016 | City People Entertainment Awards | Face of Nollywood Award (English) | Won | [7] |
2017 | Best of Nollywood Awards | Best Supporting Actress –English | Nominated | [8] |
Queen Nwokoye mari Mr Uzoma wey bi sey dem kom bon twin, two boi pikin an one gel pikin.