Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Eric |
Wen dem bon am | 6 January 1989 |
Ples wey dem bon am | Port Harcourt |
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tok | Nigerian English |
Wok wey e dey du | singa |
Wie e go skul | Covenant University, University of Surrey |
Instrument | voice |
Official website | http://richassani.com/ |
Ikechukwu Eric Ahiauzu wey dem sabi as Ric Hassani (Dem bon am on 6 January 1989) na Naija singa, song raita an musikshan.
Hassani go Covenant University wey dey Nigeria. E go Universiti of Surrey, wia e tek get masta digre in energi ekonomiks.
Hassani rilis im fest musik album The Gentleman in 2006. E get di kain way e dey holways dress wey e kol am gentle man dress. Insaid April 2023, e rilis two song di sem day, Amina an The One.
Awods Hassani nem dey insaid pipu wey sing beta song an fit awod for 2016 All Afrika Muzik Awods: Best Artiste in Afrika R&B an soul, Video of di year, an Most promising Artiste. E still get two norminashon for di Headies 2016, an Best Alternative Song for "Gentleman".
In December 2018, di Falz an Olamide song wey dem sing wit am "Believe" win Best kolaborashon at di Galaxy Muzik Awods.