Man abi wuman | man |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Alias | Shallipopi |
Wen dem bon am | 12 April 2000 |
Ples wey dem bon am | Benin City |
Wok wey e dey du | musician, rapper |
Wie e go skul | Auchi Polytechnic |
Crown Uzama (dem bon am on 12 April 2000), wey plenti pipu sabi as Shalipopi, na Naija singa, rappa, an songraita. Plenti pipu sabi am in 2023 wen e rilis '"Elon Musk" singu. E du anoda '_Planet Pluto wey bi extended pley (EP) in 2023.
Shalipopi fest studio album, Presido La Pluto, wey e rilis in 2023, sel wel wel for market, e rish nomba 1 for TurnTable Top 50. E dey insaid Apple Music top 100. Im sekond album, Shakespopi (2024), sel wel wel for market, e get singu lik "'ASAP" wey rish nomba 1 for TurnTable Top 100.
Uzama finish fom Auchi Polytechnic in 2023, na dia e tek get digre insiad Computer Science.
On 30 May 2023 di Economic and Financial Crime Commission (EFCC) arest, Shalipopi, im manager an som oda pipu bikos EFCC sey hau dem tek get moni no dey raight. Shalipopi, im manager an oda pipu get jorjmet on June 2023, wen dem tel sey mek dem uze two years for prison abi mek dem pay fine.
Title | Details |
---|---|
Planet Pluto (EP) |
|
Presido La Pluto |
|
Shakespopi |
|
Title | Release date | Album |
---|---|---|
"Elon Musk" | 14 March 2023 | Planet Pluto |
"Sharpiru" | 20 April 2023 | |
"Ex Convict" | 7 July 2023 | |
"Things on Things" | 13 October 2023 | Presido La Pluto |
"Oscroh (Pepperline)" | ||
"Evil Receive" | 8 November 2023 | |
Benin boys | 21 June 2024 | Non-album single [4][5] |