Inception | 1968 ![]() |
---|---|
Tito | The Nigerian Observer ![]() |
Kontri | Naija ![]() |
Headquarters location | Benin City ![]() |
Publisher | Bendel Newspapers Company Limited ![]() |
Language of work or name | English langwej ![]() |
Official website | http://nigerianobservernews.com ![]() |
The Nigerian Observer na evri day niuz-pepa wey dem dey poblish for Benin City, Edo Stet, Naija. Dem don dey poblish di niuz-pepa sins 29 May 1968.[1] Di pipul wey dey run am, Bendel Newspapers Company Limited, na di Edo Stet Govamet get am.[2]
For 1973, one ripota for The Nigerian Observer kom rait one tori abaut tisha wey wan strike for Rivers Stet. E hapun sey na di day Governor Alfred Diete-Spiff wan do e biday di tori kom out. Di govno si di tin as insot, di govno hasitans Ralph Iwowari kon shave di ripota head for poblik an flog am with cane 24 times. Na di forma Bendel Stet wey dey leta komot Efo Stet from dey kontro The Nigerian Observer dat time. Anoda niuz-pepa wey dey Rivers Stet wey bi The Tide no gri tok abaut di fight with di tisha.
Wen Shehu Shagari bin dey rule (1979-83), police bin dey harass pipo-dem wey dey work for di niuz-pepa. Dem go dey arrest dem an lock up dia office. Even some oda papers wen opposition party dey control, dem go harass dem too.[3] For 1989, becos of wahala with moni, di niuz-pepa con close for some time.[4] For 22 July 1993, General Ibrahim Babangida con ban The Nigerian Observer plus some oda pepas like National Concord, The Punch an The Daily Sketch.[5]
Wen dem analyse The Nigerian Observer and oda Naija papers wey dem publish for 1999, dem talk say e no too dey sell, and e get small adverts wen just dey take 15% of space wey e get, compared to 50% wey typical North American paper go get. Most of di adverts na government notice; di paper no dey make enough money coupled with di scarcity of newsprint and dis no allow dem to cover many things or do investigative journalism.[6]