Yei Theodara Ozaki

Yei Theodara Ozaki
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromJapan Chenj-am
Wen dem bon am1871, 1870 Chenj-am
Ples wey dem bon amLondon Chenj-am
Wen e kpai28 December 1932, 1932 Chenj-am
Place of deathTokyo, London Chenj-am
PapaSaburō Ozaki Chenj-am
MamaBathia Catherine Morrison Chenj-am
Pesin wey e mariYukio Ozaki Chenj-am
PikinYukika Sohma Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokEnglish langwej, Japanese Chenj-am
Langwej wey e tek rait di wokEnglish langwej Chenj-am
Wok wey e dey dutranslator, children's writer, raita, collector of fairy tales Chenj-am
Pat of wok wey e put mindtranslating activity, creative and professional writing Chenj-am

Yei Evelyn Theodara Kate Ozaki (dey bon am December 1870 an e kpai on December 28, 1932) na Japan wuman wey dey chenj Japan smol smol tori to anoda langwej for pipul to ondastand. Some pipul komplain abaut e wok but afta e kpai dey kom riprint e wok meni times.

How e tek stat life

[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for London dey bon Yei Theodara Ozaki in 1871. Ozaki papa nem na Baron Saburō Ozaki an e mama nem na Bathia Catherine Morrison wey kom from England ( dey bon am 1843 an e kpai 1936). E papa Baron Saburô Ozaki bi one of di fest Japan men to go rid in Europe or Amerika. Ozaki mama bi di gel-pikin of William Mason Morrison ( dey bon am in 1819 an e kpai in 1885) wey e bon wit Mary Anne Morrison. Ozaki mama wey dey tish in England mit Ozaki papa wen e kom len for e klass an both of dem mari in 1869.

For one buk wey Mary Fraser rait wit di tahitu "A Biological Sketch; from Warrior of old Japan and others stories" e tok sey Ozaki mama wey bi Bathia to live togeda with Ozaki papa. E stil tok sey Ozaki mama stil bon anoda two gel-pikin: Masako Maude Mary Harriett Ozaki (dey bon am in January 1872) an Kimie Bathia Alexandra Ozaki ( dey bon am in 1873 an e kpai 1964). Ozaki papa kom bak to Japan in 1873 bikos e wan mari one wuman wey e famili get mouth as dey don plan di marej sins. Di nem of dat wuman na Toda Yae. Dis one hapun bikos dey wan mek di famili nem Toda no kpai. Leta, Ozaki papa komot from Japan an get a job for St. Petersburg wey dey Russia so dat e go fit dey klose to Ozaki mama. Na in 1880 di famili of Baron Ozaki kom gri sey dia pikin rili don mari Ozaki mama an dey put e nem in di list of wife wey dey dia famili histri.